Home Page »  F »  Fela Kuti
   

Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss Lyrics


Fela Kuti Mr. Grammarticalogylisationalism Is The Boss


Now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now
Oh now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man
Him talk oyinbo pass French man
Me I say him talk oyinbo pass Germany man

The better oyinbo you talk
The more bread you go get
School start na grade four bread
B.A. na grade three bread
M.A. na grade two bread
Ph.D na grade one bread
The better oyinbo you talk
The more bread you go get

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Oh yes
Him talk oyinbo pass America man

Hear it!
One more time
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
The oyinbo wey dey inside
Petty trader no fit to know
The oyinbo wey dey inside
Market woman no fit to read
The oyinbo wey dey inside
Na riddle for laborer man

Inside the paper
Lambastical dey
Inside the paper
Ipso facto, dey that one na Latin
Inside the paper
Jargonism dey
Inside the paper
Youth delinquency dey

Who be deliquent?
Na dem be deliquent
Who be delinquent?
The oyinbo talker delinquent
Who be delinquent?
It no be me o

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man

[Fela makes up some gibberish oyinbo]

Him talk oyinbo pass Germany man
Me I say him talk oyinbo pass French man



the new hitmakers: how social media is rewriting the rules of music discovery
The New Hitmakers: How Social Media Is Rewriting The Rules Of Music Discovery
Chris Page - 05 Jun 2026
katy perry brings massive free concert to mexico fenapo festival
Katy Perry Brings Massive Free Concert To Mexico Fenapo Festival
Faith Thompson - 27 May 2026
john legend sets the stage on fire for the 2026 manhattan summer gala
John Legend Sets The Stage On Fire For The 2026 Manhattan Summer Gala
Sasha Mednikova - 13 May 2026
from the recording booth to the kitchen: when musicians become culinary obsessives
From The Recording Booth To The Kitchen: When Musicians Become Culinary Obsessives
Evren E. - 05 May 2026
the ultimate fashion playlist: unpacking the devil wears prada 2 soundtrack
The Ultimate Fashion Playlist: Unpacking The Devil Wears Prada 2 Soundtrack
Chris Page - 29 Apr 2026
Browse: