Home Page »  B »  Burna Boy
   

Collateral Damage Lyrics


Burna Boy Collateral Damage

[Hook]
Oya dey there oo
Ambassador go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (dey there o)
And President go dey chop (dey there o)
When dem say make we jump we go jump (dey there o)
Ambassador go dey chop (dey there o)
And President go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (dey there o)
When dem say make we jump we go jump

[Verse 1]
No be for here wey dem born Jesus, ehee
My country problem e pass Jesus
Because na we be our own problem, ehee
Na who go come reason well? Well well well

[Hook]
Oya dey there ooo
Ambassador go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (dey there o)
And President go dey chop (dey there o)
When dem say make we jump we go jump (dey there o)
Some people go somersault
Dem get headache we go drink Panadol (dey there o)
Meanwhile president go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (dey there o)
[Verse 2]
Na who, na who dey here?
Money dey here
The Thiefi thiefi come major
Wey make the suffer come dey here?
Suffer yapa mukutun, brukutum
Wey dey make people sukun
Tukutum, won ni inu won o dun
Brukutum, suffer yapa mutukum
The people do you well well
And dem dey laugh you well well
And dem dey see as e deh sele
Them sef dey flenjor well well
Yeah, yeah ooh
My people suffer well well
Police dey slap here well well
Hungry dey wire dem well well
Oluwa oluwa oluwa ooo

[Hook]
Oya dey there ooo
Ambassador go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (Dey there o)
And President go dey chop
Dem dey say make we jump we go jump
Some people go somersault
Dem go dey get headache no go drink Panadol
Meanwhile president go dey chop
And Governor go dey chop
[Verse 3]
My people serve they fear too much
We fear the thing we no see
One day all of us go die
We always get reason to fear
Fight for your right o you go to fear
Police go slap you, you go to fear
Fight for your pikin dem no go to fear
You go to fear fear fear

[Hook]
Ambassador go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop
And President go dey chop
Dem dey say make we jump we go jump
Some people go somersault
Dem go dey get headache no go drink Panadol
Meanwhile president go dey chop (dey there o)
And Governor go dey chop (Oya dey there o)


country thunder alberta 2026 could be calgary’s loudest early-summer weekend yet
Country Thunder Alberta 2026 Could Be Calgary’s Loudest Early-summer Weekend Yet
Chris Page - 28 Feb 2026
amy taylor’s legal battle explained: why the amyl and the sniffers photographer case is getting so much attention
Amy Taylor’s Legal Battle Explained: Why The Amyl And The Sniffers Photographer Case Is Getting So Much Attention
Sasha Mednikova - 26 Feb 2026
celebrity singer weight loss stories: what really changes behind the scenes
Celebrity Singer Weight Loss Stories: What Really Changes Behind The Scenes
Faith Thompson - 22 Feb 2026
microphone to movie star: 3 american icons who smashed box office records
Microphone To Movie Star: 3 American Icons Who Smashed Box Office Records
Evren E. - 14 Feb 2026
becky g’s anti-ice manicure ignites debate at musicares 2026
Becky G’s Anti-ice Manicure Ignites Debate At Musicares 2026
Chris Page - 31 Jan 2026
Browse: