Home Page »  F »  Fela Kuti
   

Power Show Lyrics


Fela Kuti Power Show


I open my eye I see for my land
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O
Everywhere you go
Everywhere you dey
Everybody want do power show

Na wrong show O

You reach boarder immigration
officer dey
Him go bluff you
Waste your time
Change him pants
Some dey comb dem hair
Den tidy dem table
Den dem pull dem chair
Before him go know say you dey there
If you no talk quick
Him go go for shit
Him go shit come-back
And you talk to am
Then you suprise when him
Shack for you
Him go say you no go cross
You no go cross today
Na that time dem go start Dem
Power Show O O

Na wrong show

Go post office na the same
Dem go bluff you
Waste your time
Run you up
And then run you down
Dem go tire your body
And then tire your mind
And them tire your whole mind
Dem go say no change for fifty Kobo
Na that time dem go start them
Power Show O O

Na wrong show O

Motor car owner sef him go take
him car push him car push laborer
Down for road
Then him start to yab
Foolish labourer
Nonentity, him no get money
Look him sandals e don tear finish
Look him trouser e don tear for yansh
Look him singlet e don dirty finish
Look him body e no bath this morning
Look him pocket e don dry finish
You go suffer for nothing
You go suffer for nothing
You no know me sha?
I be General for Army Office I
I be Officer for Police Station
I be secretary for government office
You foolish laborer, Nonentity,
you go suffer for nothing
Na that time dem go start dem
Power Show

Na wrong show O

Power Show
Na sad thing
Na bad thing
Na wrong show O
Power na to help your land
Na to help your mates
Na wrong show O



the digital vault: how unreleased pop albums end up on the black market
The Digital Vault: How Unreleased Pop Albums End Up On The Black Market
Evren E. - 13 Sep 2026
from streaming to the stage: how music discovery is changing concert culture
From Streaming To The Stage: How Music Discovery Is Changing Concert Culture
Sasha Mednikova - 28 Aug 2026
behind the curtains: the logistical nightmare of stadium tours
Behind The Curtains: The Logistical Nightmare Of Stadium Tours
Chris Page - 17 Aug 2026
post malone to perform at 2026 fifa world cup closing ceremony
Post Malone To Perform At 2026 Fifa World Cup Closing Ceremony
Faith Thompson - 14 Jul 2026
music, tours, and motherhood: how rihanna stays connected on the road
Music, Tours, And Motherhood: How Rihanna Stays Connected On The Road
Evren E. - 29 Jun 2026
Browse: